Timaya - Dem Mama lyrics

Published

0 925 0

Timaya - Dem Mama lyrics

INTRO I say they done come [iyo (x6)] Nothing we do them [iyo (x6)] VERSE 1 Nigeria na my country oh Bayelsa na my state oh This na reality Well e bin happen for Bayelsa oh Nineteen Ninety nine oh I swear I no go forget am oh When them k** the people oh And they make the children them orphans oh Any time wey I think am oh Water dey pour from my eyes oh Somebody say make I leave am oh But I say me I must talk am oh CHORUS I say them don k** them mama eh [eh eh] Them don k** them papa eh I say them don k** them mama Them papa them mama them papa them mama eh I say they done k** them mama eh them papa eh ah Them mama eh ah Wetin we go do iyo Do iyo Say do iyo VERSE 2 Na so them march dey go iyo Ten thousand soldiers for road iyo Ask them where them dey go Them say them dey go Bayelsa oh Which place for Bayelsa One village they call Odi oh Na im them enter our village And rape our young girls And make us homeless oh [chai] Them k** our mama iyo Them k** our ppaa iyo Them k** our brothers Them k** our sisters And make us homeless oh Wetin we go do iyo Do iyo Say do iyo Everybody dey cry oh I say Government them bad oh REPEAT CHORUS VERSE 3 I don die oh Poverty no good at all oh [chai] Everyday for Nigeria Na so the people them dey die oh Eeeehhh, our government oh Na why una make us dey cry oh OOooh, everyday for Nigeria Na so the people dem dey die oh Them commot for house for morning oh Money no dey for your hand oh Police go stop you for road Them go collect the one wey you get oh Them lay allegation for your head oh For wetin you no do iyo Before you go know My brother, you don dey inside cell oh