Lagbaja - Different Cloth, Different Occa**ion lyrics

Published

0 223 0

Lagbaja - Different Cloth, Different Occa**ion lyrics

As for me mukomuko I go talk true make devil kini? I go talk true make devil shame The dress fine …En? En! I like am o …You like am?...Lagbaja! Yes. I no' be hypocrite and pretender like tani? I no' be hypocrite and pretender like you…Liar liar! …Well it's not too bad sha But listen to me well well before you confuse The real matter o not be the dress gan Na the place you dey wear am, na him the wahala o Different different cloth for different different occasion You dey go for the church - It get wetin you go wear You dey go mosalasi for mosque- It get wetin you go wear You dey go for party You dey go Lagbaja You dey go for lecture You dey go for work o You dey travel for yonder for winter You na de go for swimming pool Applicant wey get interview se he no' go dress smart? You dey go your school You dey go for sport o You dey go for burial for cemetery I say different different cloth, different different occasion E ma gbomo Oba fOsun You want sleep for night, if you like off your dress patapata Aa na your room now But for road, for town gbangba? Haba! Aifeni peni, aifeniyan peniyan Lo nmara oko san bante wolu Pa pa dun gbe… sha sha sha dun gbe Se you never hear the word before dignity? Se you never hear the word before decency? (Repeat) Even though na free society, remember dignity decency Se anything oyinbo do, youself must copy like mumu? That our culture wey you no appreciate Na from there oyinbo dey find inspiration See o, you the original come dey copy, the copy like ignoramus You not know, you not know na we teach them father father fashion En…you no go believe…how you go believe? Ignoramus like you