Fela Kuti - Roforofo fight lyrics

Published

0 169 0

Fela Kuti - Roforofo fight lyrics

Roforofo fight... From Abeokuta city Translation to original English: She tear pata, he tear buba She tear pata, he tear buba She tear trouser, he tear pant She tear trouser, he tear pant She pull the thing commot, he tear the thing She pull the thing commot, he tear the thing All don scatter From Abeokuta city Get away F*** off Who are you? Go and die F*** away Get away Who are you? Go and s*** You dey craze I no craze F*** away Who are you, eh? Na two people dey yab so Na two people dey yab so Where them dey yab, roforofo dey Where them dey yab, roforofo dey Now listen to me now now [Chorus] Huh! Two people dey yab Crowd dey look Roforofo dey Two people dey yab Crowd dey look Roforofo dey Wetin you go see? Roforofo fight eh Wetin you go hear? Roforofo fight eh If you dey among the crowd wey dey look If you yourself You yourself dey among the crowd wey dey look And your friend Your friend dey among the two wey dey yab Tell am, tell am, tell am, tell am Tell am make him no fight o Make him no fight Make him no fight because Roforofo dey Your friend him don vex Him don vex patapata, him no go hear Your friend him don vex Him don vex patapata, him no go hear By and by By and by the fight go start By and by By and by them go fall for roforofo o Them face go be roforofo face Them yansh go be roforofo yansh Them body go be roforofo body You no go know You no go know who your friend be You no go fit help your friend Just because roforofo dey If you wan help your friend Roforofo go rub for your face If you wan help your friend Roforofo go rub for your yansh You go tell am make him no vex You don tell am before make him no fight o Make him no fight Make him no fight because roforofo dey Now listen to me now now now now [Chorus] Huh! Roforofo don change them Them go look like twins You no go know who be who Roforofo don change them Them go look like twins You no go know who be who You no go know your friend from who You don tell am before Make him no fight o Roforofo dey for there Two people dey yab Crowd dey look Roforofo dey Wetin you go see? Roforofo fight eh Wetin you go hear? Roforofo fight eh